Africa-Press – Niger. Niger state police command don arrest one 25-year-old man Abubakar Mohammed Baba, for allegedly planning wit im friend to kill im 52-year-old papa, Alhaji Mohammed Baba.
Police tok-tok pesin, DSP Wasiu Abiodun for statement on Thursday say dem attack and stab Alhaji to death for im house for Koropan community for Paikoro local goment area of di state for October last year.
Oga Abiodun explain say afta dem kill im papa, dem come cut-cut and slice di papa body come pack am put inside sack throway am for Tagwai-Dam.
Di police say around 10:30 local time for 29 December 2021, based on credible intelligence, police operatives wey dey attached to Chanchaga Division arrest Abubakar of Gidan Madara area of Chanchaga, Minna on top crime of criminal conspiracy and culpable homicide of im papa.
‘E go home for Xmas and New Year celebration na dia dem shoot am die’
However, afta plenti in interrogation, police say Abubakar cari dem go Tagwai-Dam wia dem dump di deadibodi of im papa.
Di police statement say im bin contract one of im friend, 26 year-old Aliyu to kill im papa and e agree to pay one hundred and ten thousand naira. First e pay Aliyu fifty housand naira and promise to pay am di remaining balance of sixty thousand naira if im complete di task.
Di tori say afta di friend kill di papa, e sell some of im property to raise di sixty thousand naira to pay im friend.
Although Aliyu don run from di community, di police say dem look for am and promise to catch am so dat e go face di law.
Di suspect Abubakar say im commit di act sake of say e wan shaperly inherit im papa property.
Di police say di mata still dey under investigation and dem go cari di suspect go court for prosecution afta dem chook eye for di mata.
‘No be di first time’
Tori of pipo wey dey kill dia family members sake of money or property no be new one for Nigeria.
For April 2016, police bin arrest one Umar Manu for Katsina state for allegedly killing im wife Ibrahim Fatima wey 32 years old sake of her papa wealth so dat im go inherit am.
For 2017, tori also come out say one Blessing Olumakinde Egunlae bin kill im papa over issue of inheritance for Ekiti state.
Olumakinde papa bin get six wives and 18 pikin dem sake of land sharing gbege between im and im sibling, e trail im papa to farm, attack am wit cutlass and axe and run comot for six months.
Within di period, police bin dey look for am but e later come back and surrender imself to police and dem take am go court wia dem sentence am to death by hanging.
Recently for 2021, police also arrest one man Emeh Kalu wey allegedly kill him wife to inherit her property, houses, moni for bank and business for Ebonyi state.
Pour plus d’informations et d’analyses sur la Niger, suivez Africa-Press





